Pls I am suffering. When I say London; Who Send Me? I do really mean it. Even as I type my fingers don freeze. I woke up this morning and looked at my something and the thing is looking like a 2year old something. Infact some uncircumcised 2 year old thing long pass my own.
This is the last straw. I no do again. I call my travel agent say make she change the ticket. I need to come back. I miss smelly Lagos. My dick has gone to Ukraine
She say I shd manage. It’s only a few more days. My people, I no see wetin dey this una London o and una go dey fight to come
The people dirty, dem dey were dirty cloth, dem teeth don stain. The women no get yansh and the food b like baking powder.
This na why I no renew my last 5 years visa. I stay 5years I no go anywhere. America cancel my 2 year visa after 19 years of annual pilgrimage to the place to go waste my time and money.
Now my pikin say make I come visit am. I pay millions for visa fee, I suffer for queue even after paying premium, dem come give me visa.
As I land for Heathrow one fat ‘bolo’for immigration dey ask me question. Why are u staying for just three days? I look this one.
No be him fault. Shebi our pple don useless themselves come here dey clean shit that is why u dey carry the same eye look all of us
I say, I am a titled man from Shomolu. I am also titled in Akwa Ibom. I can come and go as I like. Not ur business. He want vex. I say look me very well, if you annoy me, I turn back. Go and ask the US Embassy who cancelled my visa for no reason and ask me to come their office. I have not reached there in 2 years. Ask them
So I tell am say, u cannot one hand dey beg me to come open Duke of Shomolu office here through one scheme and on the other hand you come dey ask me funny question for Heathrow. Mbok let me pass, my pikin is waiting
So today as I stand dey look my shrunken dick, I cry for Akwa Ibom. No Akwa Ibom man will see his dick in this state and still remain here for wahtever reason.
It is very simple to be celibate in this town. If the cold no kill you the women be like scarecrow. Even the black women wey fine small by the time u pull the seven t-shirts and 15 pants wey u were u will not see dick again the thing has run away.
Mbok, remind me to respect myself and stay in my yeye Lagos and be running to uyo to eat Afang all over the place because this London no be am at al.
Kai!!! London; Who Send Me?